Nigeria police say dia arrest of former presidential candidate and human rights activist Omoyele Sowore no dey illegal, say dem no torture am while in detention.
Dis dey come few hours afta dem release di activist afta dem detain am for two days.
BBC News Pidgin bin report on Wednesday say di activist go honor police invitation, wen im reach di police headquarters, dem arrest and detain and no gree tok why dem detain for two days.
For statement, police tok tok pesin Muyiwa Adejobi say dem follow all standard procedure to arrest and detain Sowore.
E say di reason dem arrest di activist na based on credible allegations of cyberstalking and forgery plus oda offences wey dem dey investigate.
Di statement read: "we grant am bail within di 48 hours wey dey for section 35 of di constitution. Im dey aware of di allegations against am, e go appear for court soon to answer for imsef".
According to di statement, police actions on di mata dey guided by valid court order wey dem obtain.
Video wey bin dey circulate online on Friday show Sowore with bandage on im hands. Posts for im social media handles claim say police attack and break im hand inside cell.
Police however say di claim dey false and misleading, say di bandage bin dey di bag wey Sowore carry di day dem arrest am. E claim say wen di police IG see di trending pictures and videos online, e order investigation and send police doctors to check di activist but e no gree make di medical team attend to am.
Meanwhile, Sowore enta social media early Saturday morning afta im release to tok say dem go continue dia movement, say police no get anytin on am, say dem just dey show personal vendetta on am sake of how im dey tok against dia oga.
Im arrest draw attention of plenti groups, organisations and individuals including oda Nigeria presidential candidates like Atiku Abubakar and Peter Obi plus Amnesty International, Nigeria Labour Congress and im political party African Action Congress AAC.
Dem condemn im continued arrest and harassment and demand for im release, say even if im commit any offense make dem carri am go court as law tok.
Im supporters bin troop out for most police stations across di country to protest im detention.
Who be Sowore
Omoyele Sowore na journalist, human rights activist wey bin don follow contest for Nigeria presidential election.
E don collect plenti arrest and detention over di years.
Im be di RevolutionNow leader for Nigeria and Publisher of Sahara Reporters news platform.
Nigeria govment bin arrest Sowore for August 2, 2019 say im commit treason.
Dem later release am for 5 December afta e spend more dan 3 months for detention, only to re-arrest am inside court less dan 12 hours later.
On 13 December, 2019, Attorney General of Nigeria and Minister of Justice, Abubakar Malami bin take ova di case of Sowore from di country Department of State Service.
Den on December 24, DSS release di publisher afta oga Malami write to di DSS say make dem release am.
Dis latest arrest don add to plenti of him arrest timeline.
Post a Comment